I open my eye I see for my land *(CHORUS) NA WRONG SHOW O Everywhere you go Everywhere you dey Everybody want do power show
Na wrong show O
You reach boarder immigration officer dey Him go bluff you Waste your time Change him pants Some dey comb dem hair Den tidy dem table Den dem pull dem chair Before him go know say you dey there If you no talk quick Him go go for shit Him go shit come-back And you talk to am Then you suprise when him Shack for you Him go say you no go cross You no go cross today Na that time dem go start Dem Power Show O O
Na wrong show
Go post office na the same Dem go bluff you Waste your time Run you up And then run you down Dem go tire your body And then tire your mind And them tire your whole mind Dem go say no change for fifty Kobo Na that time dem go start them Power Show O O
Na wrong show O
Motor car owner sef him go take him car push him car push laborer Down for road Then him start to yab Foolish labourer Nonentity, him no get money Look him sandals e don tear finish Look him trouser e don tear for yansh Look him singlet e don dirty finish Look him body e no bath this morning Look him pocket e don dry finish You go suffer for nothing You go suffer for nothing You no know me sha? I be General for Army Office I I be Officer for Police Station I be secretary for government office You foolish laborer, Nonentity, you go suffer for nothing Na that time dem go start dem Power Show
Na wrong show O
Power Show Na sad thing Na bad thing Na wrong show O Power na to help your land Na to help your mates Na wrong show OTeksty umieszczone na naszej stronie są własnością wytwórni, wykonawców, osób mających do nich prawa.